Patience na President Jonathan wife name but na wetin Urhobos need at this time in politics. We misstep but we done dey align back.
While many people dey suggest say as GEJ no make any Urhobo Minster etc, make we pack face for am. NA VERY MUMU ADVICE.
Urhobo and Ijaw history too rich. Not one story/tale of fight or war between us. We stay together. Them dey near river, we dey the land side. We give them cassava, them give us fish...them and Itsekiri. Wahala no dey one day until oyibo come wey scatter Urhobo and Itsekiri peace.
But Ijaw and Urhobo? Wahala no dey one day. In fact, to be "pere" or King for some Ijaw areas, your mama must be Urhobo. this na so their King go be Urhobo brother.
Ibori and GEJ cassala no fit spoil our rich history of togetherness. OUR HISTORY PASS BOTH OF THEM. Them go come and go and our children go remain good neighbours as we done dey through history.
Na Ijaw make Felix Ibru win election. Ogboru wife sef na Ijaw.
Bomadi and Burutu, na so Urhobo communities dey inserted even inside Bayelsa. Fight never burst out one day or say one person oppress another.
EK Clarke mama sef na Urhobo abi Isoko abi Elder Godsday Orubebe mama be Isoko?
Na why I believe say with Aziza them wey done near Abuja now, any kind shirt wey tear between Ibori and GEJ, them go use good OBIOMA patch am.
E pain me somehow say General Mujakperuo, our Orodje no too free to join play this politics. Me I believe say GEJ for need such no-nonsense general wey IBB them know say he no dey carry laugh and dey treat eff up ONE TIME for this Boko Haram matter. General for do them how he do ecomog that year and why na him dey lead UN observer forces for crisis region.
But as una see for this photo, na GEJ and our Uhobo Kings them be this. Make una no let people wey no know politics deceive una say make we fight GEJ as Urhobos. Na mumu talk. GEJ hold yam, he hold knife. HE GO WIN but he go win easier with our help and support.
These Kings una see here, almost all na graduates. Uvwie own na serious economists wey done dey high up for the Nation echelon. I dey certain say dem clear GEJ many things.
Na second tenure Obama gree say hhe na blackman begin speak on Trayvon Martin and even done beggin funds for Black and Hispanic kids so them fit stay in school.
GEJ know say he dey owe we. But make we trrust our Kings for once as dem done say dem and him done talk. make we trust our UPU chairman general Aziza wey na him dem even put for PDP wey dey join bring back people to PDP and dey cool down all the yeye fire wey dem Amaechi light inside the party.
I done tell them Paul Akpor Abu and them Aruviere Martin Egharhevwa dey agree sometimes with me even though he dey really provoke for the perceived marginalization of Urhobos by this admin. Ejiro Etaghene done agree make we give GEJ a second chance, even though he too dey vex. And my brothers like them Michael Dedon and Franc Omor Edegware both strong believers and champions of Urhobo and Isoko interests as well as that of Delta and Nigeria, them done analyse am and see say GEJ remains the best option.
Me? As prophet TB Ena, make I talk like real prophet and say "It is God that revealed to me that I must support GEJ. That he will remain president till 2019." Okay I no hear am wey God talk am but my spirit done tell me as ENAstradamus say Urhobos just need to remind GEJ say "We want more ohhhh, but na still u we go vote. We vote you almost hundred percent last time so if u dey vex for Ibori, no use am face we. And if you feeel say any nominee too close to James Ibori, Urhobo has young sons like Okumagba Francis and the one wey ruun BGL wey be like the most sound investment house in Nigeria wey rescue AIT and dey build houses fll lagos wey average man fit afford and become owner. We get also Randolph ErumaGborie wey be SA to Agwariavwo, graduate of Uniben Business Admin Department and Masters degree holder and Lagos Business School graduate and wey done excel for business here and abroad. These men and many more dey around that fifty years....and them fit do many things for Nigeria while being Urhobo sons.Even if them appoint 'Ali Baba as Minister of Youth something something, he deserve am. RMD sef dey there. And these na people from my friendlist oh. Equally qualified Urhobos full everywhere even Emerhor wey dey gallivant with APC now, them fit call am whisper for him ear. So GEJ, no let anybody tell you say Urhobos no qualify as them Wike and all the people I dey see for power no know book or get vision reach 50 Urhobos wey I fit relax begin name, even Ayemidejor Austine are eminently qualified to be Ministers.
So Urhobos, make we shine our eyes well. We can decide to fly ship of opposition and continue to rioja or we can be smart and align. We can be smart and do big deals with GEJ on support and reward knowing POWER IS WHO GETS WHAT WHEN AND HOW.
Urhobo me na. Na as I see am from the bottom of my belle I talk so. GEJ is the way to go. All the vex una dey vex for am, remember, e no get how Fulani man go take do for you pass Ijaw man wey go retire come stay near you. If them free them Buhari, this 13 percent sef, them go commot am. Sanusi dey campaign for that one since.
My papa Chief Fred Ofuugara go say "uyovwi su" Okwo" (na brain dey lead person) Let us do thee developmental deal with GEJ.
Mi ye ri. Urhobo wadooo.

No comments:
Post a Comment